DASA RELATIONSHIP AMEBO
DASA Amebo don come again oooooo!!! Amebo just dey hear Lamba anyhow. Why una like to dey hide relationship from us na. Nobody go collect Una lover Wetin Amebo just hear? Soooo Amebo hear say one part 3 guy like that. E be like say na the person wey last year play director for the Induction use for one love play like that. We hear say hin dey date one babe for part 2. She no too fat like that na dark skinned girl wey set oo E shock Amebo sef because e dey low key dieeeeee. Nobody no even fit suspect them at all. Dem even dey one production together currently sef. ________________ We con hear again say the girl dey date anoder person for her class sef. Wahala spec lomo Oga oooo. Two timing things on point. When some people wan die single for department na him person dae two time God am I a SINGLET ??😭😭😭 So DASAITE who una tink say be the girl and the boys wey she dey dribble? Till we meet again oo Your favorite Amebo