DASA AMEBO
Keereee ooooo
Amebo don land again ooooo
Keeereee oooo
After all this gidigba weeks don pass. Make una no vex we just dey cook better gist for una na why oooo.
Amebo sha, Amebo sha, Amebo sha 😂
*In a very quiet voice*
Una know say tomboy no too plenty for our department so una go fit do una maths wella.
One tomboy dey our department wey dey happy relationship ooo.
Everything dey go wella her boyfriend even dey do... relationship dey sweet abi na wetin we think sha.
One guy kon dey wey no dey our department oooo but hin dey show face wella hin even do show sef for our pit.
This girl sha kon dey fall for the guy sha... Tom boy wey dey fall for fellow boy 😪
Na so the girl sha make sure she meet him. Na so she sha kon dey toast am. E dey normal na, but the gidigba news be wetin hin kon dey tell the guy. 😂
If you hear am, the question wey go first commit your mouth be say: "Shey na hin send you come school?"
Una wan hear am? Talk for the comment now ooo
Shey una wan hear abi make I bring another gist next week?
(Afit even bring m this week again)
👇

Comments
Post a Comment