DASA AMEBO
DASA Amebo don land again ooooooo
Hmmmmmmmmm DASA kwenu oooooo
Dasa amebo hear say part 1 students na the fresh ogbonge meat wey dey on ground. Na dem dey reign oooo.
We kon hear say no be only the hot fresh girls dem dey look, na the sweet sweet boys wey dey Luminous...
We hear say na the boys of Luminous be the hot sweet, sexy potato especially our star of the class: the main character of the entire OAU play.
Even the girls for hin class wey dey relationship sef dey use one eye look am.
Dasa amebo even hear say part 4 girls don dey cook pepper soup for am😂😂😂😂😂😂, wetin we no go see for Great Ife. D babanbari of the matter be say the girls wey dey fall no be 2, no be 3, no be 4, dem no be ...
Hmmmm Make dasa amebo no talk too much sha... 😂😂😂
Part 4 student cooking pepper soup for Part 1 guy? 😂
Taloni kopor?
For una mind na only you dey look am.😂😂
Dey play
I even hear say if person ask am if hin dey relationship. Hin dey talk say hin dey single and hin no ready to mingle.
Make I no talk too much. Until we meet again
Your favorite amebo

Comments
Post a Comment